Get Your Premium Membership

Kwarapshen - Corruption

A Poem in Pidgin English Me, ma na SARS I sabi drop bars My gun ready to blast Any youth wey dey drive cars If tattoos na your singlet We go treat you like piglet If you no gree cooperate Omo, you go catch bullet. Me ma na politician If you check, I be magician I dey "pight" my brand of "kwarapshen" Play ball, I go give you admission. My certificate na banza My account balance na fire If I like I go make yanga Even next time I go still dey power. Me ma na Naija Our mumu don end here Una plans go backfire Na my generation go matter Una vision dey our museum And we ready to change our condition Even if una kill small portion We go still carry out our mission. Lekki na the catalyst We go use am minimize fatalities We don learn all una tactics And we have all the relevant statistics Baba God na our confidence Next election una go see our relevance We dey ready- no more reluctance 2023 una go see proper sense.

Copyright © | Year Posted 2021




Post Comments

Poetrysoup is an environment of encouragement and growth so only provide specific positive comments that indicate what you appreciate about the poem.

Please Login to post a comment

A comment has not been posted for this poem. Encourage a poet by being the first to comment.


Book: Reflection on the Important Things