Get Your Premium Membership

Who Be That

He don tey Ma guy he don tey Wey monkey dey work And baboon dey talk Chai! No be today. Make I tanda Gidigba like Balogun Thunder Drop some verse like vaseline Put ugwu meta And land ponmo like four Untop dis mata. No be today He don tey Wey money dey fly From we country purse Man pikin dey hungry Man pikin dey angry. Dem say money Don turn bird Our leaders dey sleep untop water bed While we dey yawn untop pako bed. Yesterday na inside soakaway Today na inside water tank Dem keep all dem money. I tire for dis kontri Agbero boys no dey gree, Even dem omo onile own get degree. And even danfo drivers dey sing song of lamentation Inside police station. Na which kain palava be this? Dem say skool no be for all of us Say make we try ignorance But school self na one chance. Professor na gramma Even dem first class na crammer To pass na big wahala. I beg who be that Wey talk say stealing no be corruption? I beg who be that Wey just commot kirikiri Talk say him be joseph of our time? I beg who be that Wey kidnap so tey we hear say him wan sue govament? I beg who be that Wey dey dance Untop say him get thirdclass? Dem don chop national cake So tey dem no even wan remain beancake I tire for this nation I hope say dem go leave our ration. Muyideen Ayinla ©2017

Copyright © | Year Posted 2017




Post Comments

Poetrysoup is an environment of encouragement and growth so only provide specific positive comments that indicate what you appreciate about the poem.

Please Login to post a comment

A comment has not been posted for this poem. Encourage a poet by being the first to comment.


Book: Shattered Sighs