New Lagos

After amala and ewedu,
And after the round two of egusi and fufu.
Na im my eyes come dey pinch me,
Small small i dey close am.
Before i know i don dey doze,
Wetin we dey talk? I don sleep.

I see two big molue,
Wey be like aeroplane.
I come see people wey line up,
dey enter one by one.
'Yeeh!',dey no even rush,
Im be like magic for my eye.

Me too come dey near dem,
But fear kon dey catch me.
I notice sey na oju elegba we dey,
Everywhere clean like Oyinbo water.
Na only me kon dey confuse,
Becos i know understand again.

No mo agbero for road,
No more Olosho for road.
No more Iya eleko for the road,
Even those Malaam no dey.
'Hey!,be careful with it',i dey hear
One man wey be like conductor dey talk.

Shu!,"Wonders shall never end",
Na so Oyinbo dey talk am.
You need to see wetin i see,
You too no go fit believe am.
The conductor wear cloth like pastor,
Even passangers sef serious like wheel chair.

Eno teyl,we reach Okoko,
Guy 'Eda ko la ro pin o' -
You no fit under estimate people oo.
As the motor dey go jejeli,
I no see any 'Where is you particular'.
Even gala sellers no dey there.

I kon dey wonder,if dey go strike.
'Cos for Nigeria anything fit happen.
Those allah ba musa house no dey there
again,
E kon be like small London.
Na im i mellow dey look,
Dey expect wetin i go see next.

Eno teyl as the motor dey go,
Na im i see 'Where is your particular'
dey smile stop the motor-
E be like sey i dey for heaven dey watch
film-.
I kon dey use eye look for
The guy we get P.O.S for hand.

'How are you today?',one inside
dem dey blow the driver grammar.
I dey expect sey e go ask for money,
But my people,e no ask for shigbanyi.
I come dey imagine sey,
Shey na like dis things dey change?

Lagos wey i no before;
Alata,elepo,mallam,aboki,all over.
Gala seller go dey pursue you,
People wey run pass your motor.
Oga police go block you before you stop,
Den you go know "Survival of the fittest".

You go dey hear "brother Chukwudi,
The pioneer,Chief founder,President
Of 'Healings wings int'l missionary clinic".
Agbero go dey drag money
With the conductor.
You go see Nigerian wey be like indian.

E go dey tell you sey,
E new for Nigeria and e
no sabi our money wella.
He go kon collect your money,
Dupe you and even dupe your conscience.
Only you go kon dey cry.

You go kon carry Soldier go,
But before you reach there.
He don carry your money go.
Na then you go kon see preacher,
Wey go tell you sey;
'Let by gone be by gone!

I no forget,Alaba boys,
Wey go sell phone for you--
phone wey get fufu engine.
You don dey happy sey
You don by new phone-techno L8.
Na wen you reach house,you go
kon know sey na fufu you buy.

You go kon carry soldier go,
Before you come,he don go.
Na im friend you go see,
But if the soldier hold the friend,
Na den he go call am.
Den e go kon give you,your money back.

But this new Lagos,
No be like dat again.
The road be like paradise own,
the people sef be like Angel.
The people and the road ehn;
I no even know wetin to talk.

Even Ajagbandi student dey
speak konk pho-ne....
The teacher no dey hold
Long cane wey be like pole again.
The school even get plenty plenty computer,
Even every pikin get laptop.

Shu!,If Lagos be like dis,
Den,how Zaria go be?
Those Oselu* no dey chop money again,
Even,dem no dey lie again.
Only me kon dey imagine sey
Dis place na Lagos or another place?

All the beta beta thing wey i see,
Agbero kon become soldier friend.
But na dreama sha!
c.2017

Copyright © | Year Posted 2017



Post Comments

Poetrysoup is an environment of encouragement and growth so only provide specific positive comments that indicate what you appreciate about the poem. Negative comments will result your account being banned.

Please Login to post a comment

Be the first to comment on this poem. Encourage this poet.

Get a Premium Membership
Get more exposure for your poetry and more features with a Premium Membership.
Book: Radiant Verses: A Journey Through Inspiring Poetry

Member Area

My Admin
Profile and Settings
Edit My Poems
Edit My Quotes
Edit My Short Stories
Edit My Articles
My Comments Inboxes
My Comments Outboxes
Soup Mail
Poetry Contests
Contest Results/Status
Followers
Poems of Poets I Follow
Friend Builder

Soup Social

Poetry Forum
New/Upcoming Features
The Wall
Soup Facebook Page
Who is Online
Link to Us

Member Poems

Poems - Top 100 New
Poems - Top 100 All-Time
Poems - Best
Poems - by Topic
Poems - New (All)
Poems - New (PM)
Poems - New by Poet
Poems - Read
Poems - Unread

Member Poets

Poets - Best New
Poets - New
Poets - Top 100 Most Poems
Poets - Top 100 Most Poems Recent
Poets - Top 100 Community
Poets - Top 100 Contest

Famous Poems

Famous Poems - African American
Famous Poems - Best
Famous Poems - Classical
Famous Poems - English
Famous Poems - Haiku
Famous Poems - Love
Famous Poems - Short
Famous Poems - Top 100

Famous Poets

Famous Poets - Living
Famous Poets - Most Popular
Famous Poets - Top 100
Famous Poets - Best
Famous Poets - Women
Famous Poets - African American
Famous Poets - Beat
Famous Poets - Cinquain
Famous Poets - Classical
Famous Poets - English
Famous Poets - Haiku
Famous Poets - Hindi
Famous Poets - Jewish
Famous Poets - Love
Famous Poets - Metaphysical
Famous Poets - Modern
Famous Poets - Punjabi
Famous Poets - Romantic
Famous Poets - Spanish
Famous Poets - Suicidal
Famous Poets - Urdu
Famous Poets - War

Poetry Resources

Anagrams
Bible
Book Store
Character Counter
Cliché Finder
Poetry Clichés
Common Words
Copyright Information
Grammar
Grammar Checker
Homonym
Homophones
How to Write a Poem
Lyrics
Love Poem Generator
New Poetic Forms
Plagiarism Checker
Poetry Art
Publishing
Random Word Generator
Spell Checker
Store
What is Good Poetry?
Word Counter
Hide Ad