Naija Sonnet 013
Naijiria our papa land,
where you dey go?
everybody don move finish go jand
yesterday Emeka self go play lotto
whether luck go shine; make him join the band.
Our leaders self no dey help matter
Na only their pocket them know
We hope say this new one go differ
and him bar: him no go set low.
Raise your hands up Naijirians
make una embrace this change.
him no be una saviour;
but make una give am una support,
so that him go fit create that rapport
Copyright © Olise Egbune | Year Posted 2017
Post Comments
Poetrysoup is an environment of encouragement and growth so only provide specific positive comments that indicate what you appreciate about the poem. Negative comments will result your account being banned.
Please
Login
to post a comment