Get Your Premium Membership

TIMELINE

Na for Area wey we dey wey some call streets Others call gettho Most Trenches Na some won turn to jungle For wrestle and more. 4 D jungle We dey mingle to struggle Hustling and juggling Bustle and giggle together to survive We take things on things To kill time and pains. Same street wey empower you Go humble or discriminate you Base on how you take package Many na ant wey dey follow sugar If dem lick ur sweetness finish Dem go jakpa go find another. Use your intellect Because men dey disguise Like this old talk No judge the book by the cover Shine your eye but no turn beast Do good and always show kindness No mean say make you turn fool. The ladies na our muse in disguise You broke dem leave you for anoda That na motivation and inspiration For the strong, to go harder and win For the weak, excuse for revenge and more Our ladies no dey settle for small things That's why we too dey go harder for higher ground.

Copyright © | Year Posted 2024




Post Comments

Poetrysoup is an environment of encouragement and growth so only provide specific positive comments that indicate what you appreciate about the poem. Negative comments will result your account being banned.

Please Login to post a comment

A comment has not been posted for this poem. Encourage a poet by being the first to comment.


Book: Radiant Verses: A Journey Through Inspiring Poetry