I Wan Yan

I don take my eye look every 
mata
come conclude sey life no 
make sense
to sense

those wey dey **** for house 
no sabi
read even those wey dey 
feed  
the children na olodo

If  person no know him 
purpose for life
e no better sey him ask baba 
wey dey
for up?

but wait make I ask
wetin I dey try talk self
You sure sey this no be 
madness?

I here sey church people 
madness dey start
from clapping but this one na 
writing
I dey write abi this one na 
madness too?

I get questions wey I wan ask

why ebi say na  armed 
robbers no dey
dey armed again and criminals
no dey commit crimes ?

Why Abacha no gree accept 
the woman
wey give her abacha?

Why police like to dey arrest 
guys wey dey
sell cocumba for Balumba?

Why ebi sey if dey cure 
madman
him go still they talk nonsense?
Copyright © | Year Posted 2013

Poem

Post Comments

Poetrysoup is an environment of encouragement and growth so only provide specific positive comments that indicate what you appreciate about the poem. Negative comments will result your account being banned.

Please Login to post a comment

Agustin Avatar
November 28, 2024 at 9:16 PM
I greet you with the love of the Lord, expressed by John 3:16 of the Bible, "For God so loved the world, that he gave his only begotten Son, that whosoever believeth in him should not perish, but have everlasting life." Be blessed.
A   Avatar
March 8, 2016 at 11:40 AM
Onyeka, Enjoyed the way you expressed every line. Please keep writing, hope to see a new one from you again. LOVE LINDA
A  Avatar
January 10, 2016 at 3:46 PM
Onyeka Onu I enjoyed reading your excellent poem today. Thanks for sharing --SKAT
Get a Premium Membership
Turn off ads, get more exposure for your poetry, and get more features with a Premium Membership.
Book: Diverse Voices: The Poetry of Human Rights and the Pursuit of Peace