Ikechukwu Godspower
GODSPOWER ,simple meaning of Ikechukwu..
Chukwu Chineke, I no go forget you
You give me life, you give me love
You give me peace
You come make me better and give me your Ike
And since that day I come become Ikechukwu.
Na your word 0,say e go better for me say I go find
favor in your sight
Even in the sight of man (c) favour go boku (plenty)
You say I no go die before my time
The mouth wey you give me, enemy no fit stand.
If dem gather for my sake,dem go fall for my sake
You be my refuge and my strength,present help in trouble
0lu Chineke e,God e,I thank you
I praise you 2x Idinma Chineke...
cHORUS; Chukwu Chineke, I no go forget you 2X
When I dey for trouble,I cry to my God
He answer my prayer,comot my soul from katakata
The tongue wey dey lie, and the lips wey dey lie.
Na so God save me,comot me from dem hand
I go de praise you,with my whole heart
Because you love me well well.
cHORUS; Chukwu Chineke, I no go forget you 2X
Copyright © James Shobey | Year Posted 2010
Post Comments
Poetrysoup is an environment of encouragement and growth so only provide specific positive comments that indicate what you appreciate about the poem. Negative comments will result your account being banned.
Please
Login
to post a comment