Get Your Premium Membership

E Come Be Like

Intro: April 2013 Verse 1: Enter bus make we go period of JAMB Me nor dey shake cas na my third E be like chance to take blast No be mouth guy man dey jack When dem boys dey flex Christmas Momsi go cook, clean and wash Make Pikin get extra time Scatter past questions sote the pages tear Teacher throw question for class, my hand already in the air No man be dondi (at all) Cas if you persevere (persevere) You go be guru My guy, you no need voodoo I swear I stuck to my timetable Cover the whole syllables On Facebook, BB and 2go Me dey unavailable Three Months before the JAMB I been dey jack Post-UME self To secure admission that year like say I be iron shelf As Baba God pilot am The awaited day land I pieces the exam Without bullet for my hand Na make my sleepless night for pay Sure say Baba God know my pain A week later the result date My Jamb Score na 168 Damn Hook: E con be like God be bad guy Abi? Shebi? E con be like God be bad guy Abi? Shebi? E con be like God be bad guy Abi? Shebi? E con be like God be bad guy Verse 2: No be hin leave make Jacob job Esau? Na hin create Amalekites dem, con tell Saul 'kill dem all'? Even small small pikin dem wey nor know wetin dey sup? Bros J vex use he hand scatter money for black market joint E be like God be badt guy When he put that tree for eden Cas if apple nor dey Mama Cain for nor disobey Moses my guy too try Come make mistake fall hand Hin knack am pass Yemi Alade E nor come go promise land E resemble the same issue we dey face for 9ja Igbos dey vex for government, on top country matter The Government dey corrupt Some people no see food to chop Even for Malay where I dey Racism be like groundnut Mehn the good die young and wicked people dey flex Bros Jeremiah been vex Baba, if you dey watch like film Sure say you go hala 'nawa' Plus man fit loose guard hin faith Make I hear from you 'how far' (Bros J how far naw) You might also like I Can Pro Obi GOD DID DJ Khaled Hook: E con be like God be bad guy Abi? Shebi? E con be like God be bad guy Abi? Shebi? E con be like God be bad guy Abi? Shebi? E con be like God be bad guy?

Copyright © | Year Posted 2022




Post Comments

Poetrysoup is an environment of encouragement and growth so only provide specific positive comments that indicate what you appreciate about the poem.

Please Login to post a comment

A comment has not been posted for this poem. Encourage a poet by being the first to comment.


Book: Shattered Sighs