Get Your Premium Membership

You For Noh

You for noh Say I dey shine my eyez Coz na so so wahalla wey dey shine for my head top You for noh Say na I jos dey parade my gari den granot So sey hunger no go kill me now Coz if I die now, I just don die for oyibo land You for noh Say na my papa den mama na won make I travel som Make dem dey see me to as Bossu So dem go fit carry dem fugu den celebrate my dollar You for noh Na me to I for get swag Make I fit dey speak like oyibo Make smoke dey commot for my mouth abi Ha! You for noh Make I don coat Den take serfee den post post for my facebook Make my neighbors nor say me to I dey You for noh Na make me too I don grab oyibo girl-y Make I don get chwingorm kiss-y Make I don do the tin-y Make she don get belly bigg-y Make my pikins get oyibo skin-y Make dem talk like dem dey sing-y Hahahahahaha you for no Say me to I do sorm Say me too I dey Bot If I die You for noh say Ibi my stupidity wey kill me So you for noh.

Copyright © | Year Posted 2017




Post Comments

Poetrysoup is an environment of encouragement and growth so only provide specific positive comments that indicate what you appreciate about the poem.

Please Login to post a comment

A comment has not been posted for this poem. Encourage a poet by being the first to comment.


Book: Shattered Sighs